Lyrics for Oga Jesus (Story of Blind Bartimaeus) By Oluyinka Zibah
Aa aah!
I wan yarn una tory about Barti and Oga Jesus!
Chai! Barti Barti
Abeg muna hear am!
Oga Jesus!
You be miracle worker
Oga Jesus!
I come give You twale
Oga Jesus!
You be miracle worker oo
Maki I yarn una story! story! story!
(Story)
He getti one beggar, wey dey sit for
road
For Bible
Him name na barti
oh oh oh
barti, barti , Bartholomew
One day barti sabi
Say oga Jesus wan pass
He kan de happy say
This na him chance
‘David pikin’ – Jesus pity for me
Maki my eye openu o
Mak’ I be gin dey see oh oh
Oga Jesus!
You be miracle worker
Oga Jesus!
I come give You twale
Oga Jesus!
You be miracle worker oo
Busy body people wey dey where
barti dey
Bad bele people wey dey where barti dey dey
Come dey hala say
Abeg! Barti quiet Your mouth joor
‘ Think say na only You wey sabi Jesus
Abi You no know, Oga Jesus dey too busy oh oh for person like You
oga Jesus no get time oh oh
(Abeg na lie be that one joor, Jesus get time for everybody)
Bro Barti, wey no send anybody
Dey there dey shouti oh
Dey hala, dey hala
‘David pickin’ ever merciful oga
‘David pickin’ na You fit comot this gbege
Jesus Jesus papa abeg pity for me
Oga Jesus kan yarn!
Make una call that Man
Wetin make I do oh?
‘This eye na my gbege’
Abeg begin dey see joor!
Chai!
Waka Your faith don free You oh oh
(Waka Your faith don free You oh oh)
No matter Your gbege
I say
(Waka Your faith don free You oh oh)
Waka Your faith don free You oh oh
(Waka Your faith don free You oh oh)
Na so barti come dey happy!
happy!
happy!
(Waka Your faith don free You oh oh)
Na so barti come dey jumpy!
Jumpy!
Jumpy!
(Waka Your faith don free You oh oh)
No matter Your wahala
(Jesus fit do am for You)
Jesus fit do am for You
(Jesus fit do am for You)
Papa fit do am for You
(Jesus fit do am for You)
No matter Your problems oh oh oh
(Jesus fit do am for You)
Jesus fit do am for You
(Jesus fit do am for You)
Other Oluyinka Zibah Lyrics [display-posts category=”Oluyinka Zibah” exclude_current=”true”]