Skip to content
Home » G.I.T » GIT – New Year Resolution Lyrics

GIT – New Year Resolution Lyrics

    Lyrics for New Year Resolution By GIT

    [Intro]
    G.I.T hahaha
    You know how e dey be nau
    I just wan communicate sense for this song
    If You fit follow my flow You go get one or two things to learn
    See…

    [Verse one]
    If failure slap You for face, nack am back with success
    One life to live, if You think am well You go vex
    Put efforts for life make poverty become Your ex
    Make up Your mind say You no go settle for less
    Like play like play last year don end
    Bros make You reason am nau, abi You no send?
    Remember the visions wey You dey share with Your friend
    When the year just start You talk say You go change
    How far Bros wetin dey sup for Your side?
    You dey make progress abi You don dey backslide?
    I want make You get the message as You dey feel my vibe
    I no dey entertain You I wan drive some sense inside
    We no fit run this year as we take run last year
    Or else we go use poverty tie wrapper for chest
    Enough of plenty talk we need to out in our best
    My resolution na to pursue life with all zest
    The new year go work oh e no get as e be
    I go spend my energy take dey work on my dream
    No time to focus on wetin no concern me
    Bad friends and gossipers abeg please avoid me

    [Chorus]
    Laziness; God forbid no be this year
    Time wastage; God forbid no be this year
    Bad friends; God forbid no be this year
    Na my resolution be this, na You I dey tell

    Lukewarmness; God forbid no be this year
    Iniquity; God forbid no be this year
    Visionlesness; God forbid no be this year
    Na my resolution be this, na You I dey tell

    [Verse two]
    I go serve God this year so tey e go pain devil
    Spiritually, Bros, I wan enter new level
    I go press hard for prayers, blaze like an inferno
    Eat the word of God pass draw soup and semo
    Invest in myself as if tomorrow no dey
    Carry out research on my line of purpose everyday
    I no go ever give my time to wetin no go pay
    I go put force for life no matter what it takes
    One life to live oh no dulling at all
    I no go loose guard myself make I no go fall
    Plenty people dey look up to me I gat stand tall
    I no wan disappoint my generation at all
    Read books, learn skill, I go dey productive
    Work hard even when e no dey conducive
    Pay my bills bro, no time to impress
    Every talent inside me, I vow to express

    [Chorus]

    [Outro]
    Hahaha… This is to motivate You bro
    Motivate Yourself
    This year must work
    G.I.T

    Other GIT Lyrics
    [display-posts category=”G.I.T” exclude_current=”true”]

    Leave a Reply

    Your email address will not be published. Required fields are marked *