Skip to content
Home » Akpororo » Akpororo – You Show Me Love Lyrics

Akpororo – You Show Me Love Lyrics

    Lyrics for You Show Me Love By Akpororo

    Every prophecy dey come to pass oh
    The bad one You take away

    And the good one You make stay
    Baba no be me righteous pass
    But You choose to bless me
    Na Your hand I dey
    Baba, na Your hand I dey eh eh

    You don wipe away
    Every tear for my eye
    My family dem gallant
    Baba na Your work I see

    Any time wen I call
    You dey answer me oh
    I go dey follow You
    Dey follow You go oh

    You show me, show me love
    You no let enemies laugh at me now
    You show me, show me love oh, oh

    Na Your hand I dey

    Some want make I fall
    But Oluwa no gree dem
    Bad mind people,
    Dem dey plot for me to fail

    Some even waka from Naija to Benin
    Dem even send thunder
    Make e come strike me
    You wan fight the man, after God heart

    Any time when I call am
    E dey answer me eh
    Even wen I find trouble
    My God go still beat You
    That’s why I love You
    Because You get power

    You show me, show me love
    You no let enemies laugh at me now
    You show me, show me love oh, oh
    Na Your hand I dey

    You show me, show me love
    You no let enemies laugh at me now
    You show me, show me love oh, oh
    Na Your hand I dey

    Every prophecy dey come to pass oh
    The bad one You take away
    And the good one You make stay
    Baba no be me righteous pass
    But You choose to bless me
    Na Your hand I dey
    Baba, Na Your hand I dey

    You show me, show me love
    You no let enemies laugh at me now

    You show me, show me love oh, oh
    Na Your hand I dey

    Na Your hand I dey ey
    If no be You, enemy for kpai me
    You don turn every thing around for my side
    Oh God, I go dey hala Your name dey Go oh
    You show me, show me love
    You no let enemies laugh at me now
    You show me, show me love oh, oh
    Na Your hand I dey

    Other Akpororo Lyrics
    [display-posts category=”Akpororo” exclude_current=”true”]

    Tags:

    Leave a Reply

    Your email address will not be published. Required fields are marked *